I love my pastor. I love my pastor indeed. e be correct man. His God dey working well well. Me, I have not had child for eight years since I marry when all my mates them that I first to marry have born four, five child. Me I was barren. My mother-in-law come be very wicked woman that time. She call me winch and all sorts of name. she say that me I was ashawo before I marry, that I have already remove my womb and use for ritual for my small shop near filling station. But even doctor tell her that my womb is still intact, that nothing have touch it at all and me sef am not ashawo before. My mother-in-law come dey trouble my oga say make e go take another wife. My oga say he does not want another wife and I dey ok for him. But I observe and see say na lie. Manage manage no dey full bele. For the first five years I manage for my husband house upon all his mama wahala and all the small small things wey people wey come see am dey talk about my problem, dey talk different different medic