Skip to main content

Confam Woman

I love my pastor. I love my pastor indeed. e be correct man. His God dey working well well.
Me, I have not had child for eight years since I marry when all my mates them that I first to marry have born four, five child. Me I was barren.
My mother-in-law come be very wicked woman that time. She call me winch and all sorts of name. she say that me I was ashawo before I marry, that I have already remove my womb and use for ritual for my small shop near filling station. But even doctor tell her that my womb is still intact, that nothing have touch it at all and me sef am not ashawo before.
My mother-in-law come dey trouble my oga say make e go take another wife. My oga say he does not want another wife and I dey ok for him. But I observe and see say na lie. Manage manage no dey full bele.
For the first five years I manage for my husband house upon all his mama wahala and all the small small things wey people  wey come see am dey talk about my problem, dey talk different different medicine wey we go fit use.
But the thing wey come touch my heart. The thing wey pain me well that time na those small small girls that never reach to marry wey go come dey gather around my husband like fly wey dey follow pammy. Those little little girls wey go dey give am eye. One day na so I go my husband office, e dey work for one law office like that, and I no tell am. As I just enter him office I see am with him secretary and dey now do as if they are talking before I catch them. The thing tire me well well. I run comot go my pastor.
I dey cry
‘Man of God, I am tired. Why baba God is doing me like this? Eh? Why e dey punish me?’
As I dey talk na so my pastor dey look me like AIT. I dey expect make he tell me that it is my mother in law that tie my womb as I don dey suspect the old winch since (when I pray I go always curse am for my prayer). my pastor look me finish as I do all my cry cry. He now tell me say God dey work wonders, say na the right time God dey always wait for. I have marry since eight years! Which one be right time again?
I kneel down dey beg my pastor say make he help me beg God so God go give me at least one pikin make I show people say I sabi to born too, say I be woman. I dey cry like say na now now the pikin go drop.
‘Sister Monica’ my pastor call me before I stop ‘God can use anyone to bless you’ I say amen but I don’t know if its prayer.
Then my pastor carry me go upstairs to parsonage, he say for special prayer. As I enter, my pastor enter and lock the door.
He say
‘Sister Monica, God would answer your desperate cry and he would use me to answer it’ as he dey talk he dey remove belt, dey remove trouser. He see as I siddon dey open mouth.
‘Abi, sister monica, don’t you want a child?’
I say ‘Yes’
Hm. The thing wey I take my eyes see that day ehn.  My pastor sabi! No be like my husband own.
One month later I go to hospital for test and they tell me I get bele. I am pregnant!
All those thing wey my mother-in-law dey do me go stop. All those yama yama girls no go dey round my husband again. My husband sef go see say I be Confam woman.

©Kay Ugwuzor
2016

Comments

Popular posts from this blog

The Famished Road | Readings

‘If  you  misbehave the same thing will happen  to  you.’ ‘What?’ ‘The  forest  will  swallow  you.’ ‘Then  I  will  become  a  tree,’  I  said. ‘Then  they  will  cut  you  down  because  of  a  road.’    ‘Then  I  will  turn  into  the  road.’   ‘Cars  will  ride  on  you,  cows  will  shit  on  you,  people  will  perform  sacrifices  on  your  face.’   ‘And  I  will  cry  at  night.  And  then  people  will  remember  the  forest.’ Azaro and Madame Koto  Excerpt from  The Famished Road By Ben Okri. Pg 164 Azaro is surrounded by myths and mysterious things that no ...

A New Dream Of Politics | Ben Okri | Poetry

They say there is only one way for politics. That it looks with hard eyes at the hard world And shapes it with a ruler’s edge, Measuring what is possible against Acclaim, support, and votes. They say there is only one way to dream For the people, to give them not what they need But food for their fears. We measure the deeds of politicians By their time in power. But in ancient times they had another way. They measured greatness by the gold Of contentment, by the enduring arts, The laughter at the hearths, The length of silence when the bards Told of what was done by those who Had the courage to make their lands Happy, away from war, spreading justice And fostering health, The most precious of the arts Of governance. But we live in times that have lost This tough art of dreaming The best for its people, Or so we are told by cynics And doomsayers who see the end Of time in blood-red moons. Always when least expected an un...

Short Story Fiction ~ On Top

Odd. Yes. That’s the word to describe the feeling when he’s on top of you, inside of you, thrusting rapidly like a mad man before he comes. You cannot feel anything but the hair on his chest. His husky breathing pollutes the air around you. His large belly seems to fill the space of the bed, he is surprisingly light.      As soon as he is done, he rolls off you and crashes into the bed, breathing a sigh of relief. He chuckles and prods himself on an elbow and looking into your eyes with a wide grin on his ugly mouth. He asks how you feel and if he was good. You want to say you hated every second of it but you simply ask why he had to be on top and he says a real man must always be on top.   You get off the bed and walk to the bathroom, with a tackiness between your legs. You lay in the tub staring at the tiled wall; the hot water doesn’t seem to wash away your filthiness. The soap smells nice however and you wrap it in your underwear to take it out...